Na gbola de save me for this Lagos part 1
Na Gbola dey save me for this Lagos! (By Angela Nwosu) My name na Matthew Ekwunife, but my street name na touch something. Na wetin my guys dey hail me, whenever I land fine girl for free. I come from poor background, my family no get shishi, we no get house for villa, na for my uncle house all man dey squat whenever we go villa. No be say we dey even go steady, transport money wey be like house rent now. E don pass 10 years wey I see my village. I be 3rd born, I get 2 elder sisters and 2 young